Oga Presido,
First of all I hail ooo! I no say u no dey cary last. You be confirm warri
pikin. But ur middle name Ebele means mercy and make u pity ur
children settle their lecturers naa! The matter neva tire u? Suppose say
ur pikin wey u born for belle follow us dey house, Sheeh you for never
answer our we lecturers them? Una say make we bone kidnapping,
militant things and all the bad bad things go enter school, now now na
una com dey f**k up. All the things wey them lecturers don teash us
for klass we don forget am finish. Last last, na una go still call us “half-
baked”, “half-roasted”, abi na “half-fried”. Na una sabi.
Them talk say person no fit run pass him shadow.
We go dey lasgidi dey for you. Na ur time be dis use am well, but we
go catch you for 2015. U don forget say youths na we dey vote pass. Na
we too dey snatch ballot box, dey do rally and som kain kukere things
them wey them dey take win election. U go still nid our help. That
time too we go go strike. Shebi u sabi waka for bare feet, u go carry ur
leg do ur rally. No thugs for u. We no go snatch ballot make you for
win. If any maga try am we go fall am.
So Oga Jona, na ur opportunity be dis ooo. Make u code this stubborn
ASUU make dem cary their wahala goback. We no say na rush them go
rush us we no send. All join. Na who get leg dey pass exam no be who
read. Na still who get leg dey get beta work. Na Naija we dey. So make
u do something because our mate dem for private university don graj
finish. We don tire to dey beef them. If u no shake bodi fast make u no
forget say university of militancy still dey admit. Dey neva release 2nd
batch ooo!
May u grit maale Patience for we, thank baba God say she and gran
papa Soyinka don settle that their quarrel, 2 agbayas, plus all those bad
belle advisers wey u get. God pass them! Bros Amaechi still dey Niger-
delta here, the guy don tire for ur mata. We dey grit u for am too. We
go stop for here. E go be na. Naija! student for life!
Na ur waffi boy. .
Saturday, 12 October 2013
Filled Under:
LMFA0000 Hilarious Pidgin Open Letter to President GEJ on ASUU Strike
Posted By:
Top Blogger
- 03:06
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
Popular Posts
-
The quietly publicized, Wizkid Live Abuja Invasion held Last Night. Folks in attendance were stunned with the number of people who showed up...
-
Kim K for me . Who wore it better for you ?
-
When you see that girl and you try and talk to her don't drop out and start talking stuff that she does not care about. You need to talk...
-
It has been reported that Academic Staff Union of Universities (ASUU) National President Dr. Nasir Faegehas declared that the strike will co...
-
I love this. Who rocked the Alexander Wang T- strap sandals better? Rihanna or Elohor?
-
Since she started dating Nollywood actor Jim Iyke, Ghanaian actress Nadia Buari has become a scarce face on the screen due a rare love bug t...
-
With a repertoire to rival the most outlandish Saudi and Russian mega- yachts, the Nirvana is causing a bidding war among billionaire sailo...
-
Peter Okoye's fiancee Lola Omotayo visited Elaine Shobanjo's makeup studio in Lekki on Tuesday and got this exquisite ShoMya bridal ...
Join the Team
-
Blogger news
-
Latest Photos
-
Labels
- asuu
- Browsing Tweaks
- chris brown
- church
- davido
- Don Jazzy
- Entertainment
- etc
- fashion
- Foreign
- funke akindele
- justin bieber
- kanye west
- karen igho
- kim kardashian
- Local
- mercy aigbe
- mercy johnson
- mosques
- Music
- nicki minaj
- nigeria
- PHOTO OF THE DAY
- photos
- psquare
- rihanna
- rita dominic
- social media activists
- sports
- tech
- toke makinwa
- toyin lawani
- wizkid
-
Popular Posts
-
The quietly publicized, Wizkid Live Abuja Invasion held Last Night. Folks in attendance were stunned with the number of people who showed up...
-
Kim K for me . Who wore it better for you ?
-
When you see that girl and you try and talk to her don't drop out and start talking stuff that she does not care about. You need to talk...
-
It has been reported that Academic Staff Union of Universities (ASUU) National President Dr. Nasir Faegehas declared that the strike will co...
-
I love this. Who rocked the Alexander Wang T- strap sandals better? Rihanna or Elohor?
-
Since she started dating Nollywood actor Jim Iyke, Ghanaian actress Nadia Buari has become a scarce face on the screen due a rare love bug t...
-
With a repertoire to rival the most outlandish Saudi and Russian mega- yachts, the Nirvana is causing a bidding war among billionaire sailo...
-
Peter Okoye's fiancee Lola Omotayo visited Elaine Shobanjo's makeup studio in Lekki on Tuesday and got this exquisite ShoMya bridal ...
-
© 2013 iPRESS. All rights resevered. Designed by Templateism

0 comments:
Post a Comment